2 September, Monday, 2024
No menu items!
HomeSourcesbbc.comMental health: Toluse Francis: Nigerian therapist share im personal journey to overcome...

Mental health: Toluse Francis: Nigerian therapist share im personal journey to overcome depression, highlight need to seek help

Toluse say im journey don teach am to appreciate community more.

Di view of di Pacific Ocean, as you dey pass third mainland bridge for Lagos, Nigeria, na nothing short of captivating. Di waves dey clap for di coastline, to create one gigantic, calming pool of wonder. But for me, dis no always be di case; for one point, e dey serve as reminder of misery and everytin wey bad.

Meet Toluse Francis, one 35-year-old mental health professional and counsellor, from Lagos, Nigeria. Dis na im journey out of di bottom of depression. Despite wetin many dey tink say “healers” dey immune to mental health challenges, Toluse experience show otherwise.

For late 2020, Wen Covid-19 pandemic dey high, Toluse begin notice one gradual loss of interest for many aspects of life. E dey avoid social outings, suffer from insomnia, and get little appetite. Loneliness come become im constant companion. Soon, im mind don grow cover for darkness, and e dey consider to end am all.

Globally, one pesin dey take dia own life every 40 seconds, e pass annual war-related deaths.

Sourcebbc.com
RELATED ARTICLES

Most Popular

Recent Comments