8 September, Sunday, 2024
No menu items!
HomeSourcesbbc.comImran Khan: Pakistan ex-PM shot and wounded inside one protest march

Imran Khan: Pakistan ex-PM shot and wounded inside one protest march

Wia dis foto come from, RAHAT DAR/EPA-EFE/REX/Shutterstock

Dem shoot Pakistan former prime minister, Imran Khan and wound am for leg for one attack as im lead one protest march for di  eastern city of Wazirabad.

One senior aide tell AFP news agency say na “attempt to kill am”, but police neva still fit confam if im be di target.

Members of im PTI party tok say anoda four pipo injure for di shooting.

Oga Khan, 70, bin dey di march on di capital Islamabad to demand sharp elections afta dem comot am from office for April.

Sourcebbc.com
RELATED ARTICLES

Most Popular

Recent Comments