5 September, Thursday, 2024
No menu items!
HomeSourcesbbc.comElon Musk don buy Twitter for $44bn

Elon Musk don buy Twitter for $44bn

Wia dis foto come from, AFP

Di world richest man, Elon Musk, don complete im $44bn (£38.1bn) takeover of Twitter, according to US media and one investor inside di firm.

E tweet say “di bird is freed,” for wetin be like say e dey refer to di closing of di deal.

Reports say dem don fire some top executives, including di boss, Parag Agrawal.

E bring to a close kasala wey make Twitter go to court to hold di billionaire to keep to di terms of di takeover deal e bin try to escape.

Sourcebbc.com
RELATED ARTICLES

Most Popular

Recent Comments