Wia dis foto come from, Getty Images
Protesters march to complain about di general economic hardship
Hundred of pipo for Ghana enta street on Saturday, 5 November to protest de rising cost of living for de kontri capital Accra.
De protesters want make President Nana Akufo Addo, Vice President Dr Mahamudu Bawumia and Finance Minister Ken Ofori Atta resign over dia failure to address di kontri economic crisis.
Dem also want de govment to take practical measures to deal wit di current economic hardship.