22 September, Sunday, 2024
No menu items!
HomeSourcesbbc.comGeneral Brice Oligui Nguema, Ali Bongo & Gabon coup: Videos wey show...

General Brice Oligui Nguema, Ali Bongo & Gabon coup: Videos wey show suitcases of money afta di Gabon coup na true?

Wia dis foto come from, Getty Images and snip

Following di way dem remove Gabonese president Ali Bongo Ondimba from power, some videos claim to show former goment officials wey dem arrest wit suitcases wey money full inside. Di videos don dey circulate online.

But di BBC don establish say at least one of di videos dey mislead pipo.

Di video show di 2022 arrest of di former president of di Gabonese National Assembly, Guy Nzouba-Ndama.

For di video, oga Nzouba-Ndama dey for middle of a crowd behind one truck as dem break di locks on two suitcases wey reveal say CFA francs notes full inside.

Sourcebbc.com
RELATED ARTICLES

Most Popular

Recent Comments