30 August, Friday, 2024
No menu items!
HomeSourcesbbc.comWetin be Blue Economy: Wetin Marine and Blue economy mean for Nigeria...

Wetin be Blue Economy: Wetin Marine and Blue economy mean for Nigeria And di new minister Olubunmi Tunji-Ojo go do

Wia dis foto come from, Getty Images

For many pipo for Nigeria, Blue Economy go be like new word, but dem no sabi say more dan 3 billion pipo for di world dey use am for dia livelihood and 40% of di population for di world dey live near am.

Make we surprise you, Blue Economy dey generate around $1.5 tiillion per year wey make am di seventh largest economy for di world and e dey projected to double to $3 trillion by 2030, according to di Commonwealth.

But dis na one economy wey Nigeria never begin dey invest into and so much focus never dey ontop am.

Infact, as important as Blue Economy dey for di Sustainable Development Goals (SDGs) wey dey touch on everything wey we dey do for life, Nigeria no put plenti strength to develop am.

Sourcebbc.com
RELATED ARTICLES

Most Popular

Recent Comments