21 September, Saturday, 2024
No menu items!
HomeSourcesbbc.comPaternity test for Uganda dey cause tok-tok as some pipo no want...

Paternity test for Uganda dey cause tok-tok as some pipo no want am

Wia dis foto come from, TRACY NAKUBULWA

Wit reports wey tok say men for Uganda wey dey seek paternity tests don increase, fears fear dey grow say dis kain tin fit break up families and also affect di pikin psychologically.

Di issue na hot topic of debate for di kontri since one newspaper publish one tori wey claim say one well-known business tycoon – wey get plenty wives and mistresses – get kwanta wit one of im wife and dis one ginger am to request for paternity tests wey reportedly show say no be im be di biological papa of only 15 of im 25 pikin dem.

Di tycoon and im family neva comment publicly and di tori neva dey independently verified.

But di tori spread like wildfire and has caused huge tok-tok ova di last few months wey make lawmakers to make emotional appeal to men say make dem stop to dey put dia families and pikin through trauma of tests.

Sourcebbc.com
RELATED ARTICLES

Most Popular

Recent Comments