5 September, Thursday, 2024
No menu items!
HomeSourcesbbc.comMagistrate court remand medical doctor for alleged wife battering

Magistrate court remand medical doctor for alleged wife battering

Di court remand di medical doctor to prison custody as e no fit meet di bail conditions

One medical doctor wit di University of Port Harcourt Teaching Hospital UPTH dey di Port Harcourt Correctional Centre for alleged assault of im wife.

Di police bin charge di medical doctor go di Magistrate court on a one count of  assault occasioning harm.

Though di court grant am bail afta e plead not guilty to di charge, di doctor no fit meet di bail condition so e dey di Port Harcourt Correctional Centre.

Di medical doctor allegedly beat-beat  im wife and son wey  come make dem runaway from dia house for safety.

Sourcebbc.com
RELATED ARTICLES

Most Popular

Recent Comments