Wia dis foto come from, OTHER
Ghana Police Service invite dancehall musician, Shatta Wale to assist dem in dia investigation into de murder of music manager, Fennec Okyere.
Shatta Wale make claims on social media say music manager, Nana Asiama Hanson aka Bulldog know something about de murder wey happen in 2014.
Inside statement dem talk say “Police make contact wit Shatta Wale who dey cooperate wit dem on de matter.”
Dem explain say “dem dey work for months on all unresolved murder cases, including Fennec Okyere.”